Date 2021-07-11
Category Lyrics, Music Video, Naija Songs, New Music
Sound Sultan – Mathematics (Jagbajantis)
https://mpmania.com/wp-content/uploads/2021/07/Sound_Sultan_-_Mathematics_Jagbajantis_dmca
Watch Video
[Intro]
All stand, greet.
(Good morning sir!)
Good morning, you are welcome to Jagbajantis High School.
My name is Sound Sultan your new mathematics teacher.
By the way, do you understand pidgin English?
(Yes sir!)
Okay, na wetin we go use henceforth.
Okay, carry your biro, carry your paper.
Eh.
[Verse 1]
People of this world them plenty.
(Shetigbo?)
Sins of these people many, so many.
(Shetigbo?)
Many times plenty, multiply am.
(Multiply am)
Many times plenty, multiply am.
(Multiply am)
Multiply am. The answer you get na wetin dey make poor man dey cry.
The answer you get na wetin dey make rich man dey mess and leaders dey lie.
The answer you get na wetin dey make young boys and girls join bad gang.
The answer you get na wetin dey make innocent man rot inside jail.
Kere, kere.
And them no fit to grant bail
Kere, kere.
Oh oh oh.
[Chorus]
Everybody. Oya o.
Join Jagbajantis, solve mathematics,
Wey dey dabaru our continent.
So, oh oh.
Oyinbo say,
Na BODMAS we go use take, solve mathematics.
So follow Jagbajantis.
Oya carry biro.
B for brotherhood.
(Love your neighbour as yourself, otan oh.)
O for objectivity.
(Be objective gentlemen and ladies)
D for democracy. Democracy
(No matter how bad it is, e better military)
M for modification.
(Of our behaviour, let’s turn to our saviour)
A – Accountability.
(If you been dey chop money, abegi take am easy)
S for solidarity.
(United we stand. Divided, omase oh)
[Verse 2]
We enter new millennium.
(Shetigbo?)
Nigerians like one-twenty million. Won po gan.
(Shetigbo?)
World population na six billion.
(Six billion)
Divide that one by one-twenty million, altogether, oya.
(Altogether)
The answer you get na wetin dey make people dey jah, commot for naija.
The answer you get na wetin dey make people dey travel, by hook or by crook.
The answer you get na wetin dey make people dey sleep for embassy for visa.
The answer you get na wetin dey make people dey sell them property for ticket.
Kere, Kere.
And them go travel sibe sibe
Kere, kere.
Oh oh. Eh.
[Chorus]
Everybody. Oya o.
Join Jagbajantis, solve mathematics,
Wey dey dabaru our continent.
So, oh oh.
Oyinbo say,
Na BODMAS we go use take, solve mathematics.
So follow Jagbajantis.
Oya carry biro.
B for brotherhood.
(Love your neighbour as yourself, otan oh.)
O for objectivity.
(Be objective gentlemen and ladies)
D for democracy. Democracy
(No matter how bad it is, e better military)
M for modification.
(Of our behaviour, let’s turn to our saviour)
A – Accountability.
(If you been dey chop money, abegi take am easy)
S for solidarity.
(United we stand. Divided, omase oh)
[Verse 3]
You dey stay AJ city. Eh,
(Shetigbo?)
And him dey stay VG city.
(Shetigbo?)
Find your level for AJ city.
(AJ city)
Na rich man corner be VG city.
(VG city)
Try add AJ and VG city, all together. Oya
(All together)
The answer you get na wetin dey make rich man oppress, na them suppress.
The answer you get na wetin dey make poor man dey press, but then agress.
The answer you get na wetin dey make poor man dey try to keep up with the joneses.
The answer you get na wetin dey make poor man pikin dey try to prove for him mate.
Kere. Kere.
My pocket money don dey finish.
Kere. Kere.
Oh oh. Eh
[Chorus]
Everybody, Oya o.
Join Jagbajantis, solve mathematics.
Wey dey dabaru our continent.
So, oh oh.
Oyinbo say,
Na BODMAS we go use take, solve mathematics.
So follow Jagbajantis.
Oya carry biro.
[Verse 4]
Situation in this nation
Disposition, our condition
Unexplainable pain in our hearts not to mention
Brothers killing brothers for the wages adoration
Resolutions are made
For all we’ve made we lack conviction
And perfection is the order as we keep seeking solutions
Only God can solve, this mathematical equation.
[Outro]
Thanks for your contribution
Now any more question?
(No sir!)