Date 2021-08-11
Category Lyrics, Naija Songs, New Music
1da Banton – Untop Untop (prod. Pimp Beatz)
If you reason am o you go fit mad o
Them say because you never get e money o them say you no be somebody o,
Oluwa give you your money o, so you go fit be somebody o
Shey untop untop, Shebi we go Dey untop o
Me and my guys untop shebi we go Dey untop o
Na plenty pressure man Dey face, so many shit go
Dey your face, plenty hurdles for the race, plenty plenty time Dey waste
Shey Oluwa you been tell we say you no go let we down
Oluwa you been tell we say na you go lead our way
Say as e be na so I talk am
Say as e be na so I talk am
Say my guy I no fit fake am o
Say as e be na so I talk am
Say as e be na so I talk am
Say my guy I no fit fake am o
You see this life wey we Dey say my guy it’s very funny
Say at the end of the day say it’s all about the money eh
Them say because you never get e money o them say you no be somebody o,
Oluwa give you your money o, so you go fit be somebody o
Shey untop untop, Shebi we go Dey untop o
Me and my guys untop shebi we go Dey untop o
Sometimes sometimes I know say you Dey feel
like make you give up o yeye
No cry no cry brother man make you still try o yeye
Na only you know as e Dey do you gan
No go take your life compare another man life
Everybody just Dey try to survive for the street o
That’s why we Dey grind and Dey pray o
Every other day so our hustle go Dey pay o
No let nobody tell you say you no go make am
Them say because you never get e money o them say you no be somebody o,
Oluwa give you your money o, so you go fit be
somebody o
Shey untop untop, shebi we go Dey untop o
Me and my guys untop shebi we go Dey untop o
All my life I’ve been on the grind
Making mad songs everyday every night
There’s one thing wey me want you understand
Badman ah Everblazing
Back to the matter I dey try to tell you
Hustle for your family and hustle for your guys
And if anybody dey tell you say you no go make am, tell them you are ever blazing
Them say because you never get e money o them say you no be somebody o,
Oluwa give you your money o, so you go fit be somebody o
Shey untop untop, Shebi we go Dey untop o
Me and my guys untop shebi we go Dey untop o
If you reason am o you go fit mad o
Banton ahhh
Badman Deyya ooo