MpJokes: My Problem

Date 2013-06-26

Category Entertainment, JOKES

Blackberry don chop my
money tire,
na im I come vex
yestaday sell am, come
take some
money buy China phone!
Now am in bigger
trouble!!!
1. E go full after 3
minutes of charging.
2. The phone get TV,
Touch screen, Nail
cutter,
Firelighter etc.
3. I fit write Text
message with a
toothp!ck sef.
4. The spelling get
mistakes e.g NokLa,
blackderry, i-p0rn,
samswag etc.
5. When aeroplane pass
e go record “One missed
Call”.
6. When a big truck horn;
e go show “Charger
connected”
7. When Chinese man
pass e go show: “One
Bluetooth device found”
8. When fine gal waka
pass, e go show “Ur
favourite
food found”
9. When ugly gal waka
pass, e go show, “Virus
detected”
Abeg I wan sell am!
Who wan buy ooo?
Even as I dey find buyer,
e dey show me for
screen:
“No contact found”
Abeg, who want buy?

+Comment

Drop A Comment